Date: August 15th, 2026 5:31 AM
Author: zarathustra
Former Cambridge University academic Jason Arday don die afta accuse of magomago
Jayson Arday
Wia dis foto come from, ITV / Shutterstock
Published
14 August 2026
Read am in 5 mins
Di former University of Cambridge professor wey for di centre of plagiarism don die.
Dem find Jason Arday "unresponsive" for one address for Battersea, south London, on Friday afternoon, emergency services tok.
Di London Ambulance Services bin call Metropolitan Police officers. One 41-year-old man bin dey pronounced dead for di scene and im next of kin don dey informed, di force tok.
Arday bin resign as Cambridge professor of sociology of education last week afta allegations of plagiarism and questions about some of im achievements. Im bin deny di claims.
For one statement, di Met Police say: "At dis time, we dey treat im death as unexpected, but e no dey believed to dey suspicious."
Di 41-year-old academic bin denied any plagiarism - but admit say errors dey for im work - and last week e say di recent kasala bin lead to how pipo dey chook eye for im mata and dey attack am personally.
Skip content and continue reading
Wetin dey happun to Nigerian football, why Eagles, Falcons, odas dey struggle - NFF set up committee to investigate
14th August 2026
US neva comot Nigeria from list of 'country of particular concern' – here na wetin don happun so far
14th August 2026
Authorities confam release of US missionary pilot from Niger Republic
14th August 2026
End of content
Di mata first start afta anoda academic - self-defined "race realist" Nathan Cofnas, wey dem sack from im Cambridge role for 2024 - say e find plenty instances of plagiarism inside Prof Arday work and question some of im stated achievements.
Dem bin hail Arday appointment as Cambridge youngest-ever black professor for 2023 as progressive moment.
Some critics say na racism motivate di way dem treat am, but odas tok say di claims of plagiarism dey legit.
Arday, wey announce im resignation last week, say di "personal cost" of di scrutiny no be small tin.
E say: "While criticism na inevitable part of academic life, wetin I don experience don go far beyond scholarly disagreement.
"Di relentless accusations, speculation and public commentary don take ogbonge toll on me and on dose wey I love."
E say make pipo no mistake im resignation "as acceptance of di narratives wey don surround me".
BBC News Pidgin bin report say one group of academics bin call for independent investigation into di appointment of Arday.
Di professor of education also dey face accuse say e forge or exaggerate some tins for im CV.
E don defend imsef and im work.
Pipo bin turn dia attention to how Cambridge university take dey handle di concerns about Arday, wey bicom dia youngest-ever black professor for 2023, plus im upcoming memoir.
Priyamvada Gopal, professor of postcolonial studies for Cambridge, wey also dey among dose wey dey call for independent investigation, say di university dey face "big reputational damage" ova di affair.
Meanwhile, Cambridge University express sadness ova di death of dia former employee, Arday, for one statement ontop dia official Facebook page.
Dem say: "We dey desperately sad to hear dis tragic news. Our heartfelt sympathy go to Jason Arday family and friends for dis incredibly difficult time."
How di mata take start?
Na Nathan Cofnas – one US researcher and self-defined "race realist" first raise alarm and accuse Arday of plagiarism for im work.
Dem bin terminate Cofnas appointment afta pipo criticize one view wey e hold, wen e tok say if under a true meritocracy, black pipo go "disappear from almost all high-profile positions apart from sports and entertainment".
E claim on Substack say im put Arday work through one plagiarism detection software, wey discova say "e lift many passages from oda pipo work, wit small editing, and for some cases, e retain copy-editing mistakes wey dey di original source".
Cambridge initially bin describe di allegations against Arday as "vile campaign to undermine im credibility".
Liverpool John Moores University - wey award am im PhD for 2015 - bin investigate di accuse of plagiarism wey dem raise against im thesis last year, but dem no file any charges against am.
Who be Jason Arday?
Dem born Jason Arday for 1985 for London, United Kingdom.
E no fit read or write until im be 18 years old becos dem diagnose am wit autism and global development delay for im early years. And im no fit speak until im be 11 years old.
For 2023, im become di youngest-ever black professor for Cambridge University for UK.
E say im formative moments include watching Nelson Mandela release from prison on television and South Africa symbolic triumph for di 1995 Rugby World Cup.
Arday remember im dey always dey deeply moved by di suffering of odas and strong compulsion to act.
"I remember thinking if I no make am as a football player or a professional snooker player, den I wan save di world," e tok.
Im mama play ogbonge role in developing im self-confidence and skills.
She introduce am to a wide range of music in di hope say dis go help how im dey learn language.
But e also kick-start one lifelong interest in popular culture wey don characterise some of im research.
"I dey always feel say na privilege to get a period of 11 years wia maybe I no fit speak and follow pipo tok wen evribodi else fit tok becos e allow me see tins in a different way," Jason tok.
Dem diagnose am wit autism at di age of three.
Arday get degree for Physical Education and Education Studies from di University of Surrey bifor e train as PE teacher.
E get two masters qualifications and one PhD in Educational Studies.
https://www.bbc.com/pidgin/articles/cd7lw0epz30o
(http://www.autoadmit.com/thread.php?thread_id=5893318&forum_id=2ค1¤7PHPSESSID=188a95202f833e097d78c96d76bac3f6#50069270)