Date: September 25th, 2025 10:27 AM
Author: AZNgirl Charging AZNman $100k to Say Hi To Her
Why US wan scrap H-1B lottery visa and wetin dem wan use replace am?
Di Donald Trump administration wan scrap di H-1B visa lottery.
Dem go replace am wit a wage-based selection system wey go favour applicants wey go pay higher.
Under di plan, workers wey dey earn big salary go receive multiple entries wey go boost dia chances, while entry-level candidates go get only one.
Dis dey come afta dem increase di fee to $100,000 per application.
Critics dey warn say di move dey tilt to opportunities toward tech giants ova startups, while India wey dia nationals secure ova 70% of H-1Bs- fit face major impacts.
If dem finalise dis new process, e go give heavier weight to applications wey employers wey get high wages. If di annual request for di visas pass di statutory limit of 85,000.
Wetin be di aim of dis visa
Di US govment say dis move na to protect Americans beta from unfair wage competition from foreign workers.
President Donald Trump bin launch wide-range immigration crackdown afta enta office for January.
Dis immigration crackdown include a push for mass deportation, dem dey also try to block citizenship for children of illegal immigrants for di U.S.
Recently di administration bin chook eye for di H-1B program, wey dey popular wit tech and outsourcing companies wey dey hire skilled foreign workers.
Trump administration bin tok on Friday say dem go ask companies to pay $100,000 per year, and open new tab for H-1B visas.
Some ogbonge tech companies bin warn visa holders to stay for di U.S. or make dem return sharp-sharp.
Dis don spark beta rush as pipo dey try to return to di U.S but di White House bin later clarify say di fee to opens new tabs go only affect new visas.
Dis planned regulation wey dem post on Tuesday go change di existing lottery process to obtain di visas.
If pipo wey want di visa high pass di number of pipo dem suppose give in a year, di pipo wey get higher-paying jobs go get beta chance for selection..
Di process to finalize dis regulation fit take months or even years. Di notice suggest say di new rules go dey in place for di 2026 lottery, dat means e fit happun before March registration period.
Trump, wey be Republican, dey try to reshape di H-1B process during im 2017-2021 presidency, but e no fit complete am sake of federal courts and limited time wen presidency bin wan end.
One regulation wey resemble dis one bin open new tab wit di aim to shift di lottery process toward higher-paid applicants bin dey delayed by Trump Democratic predecessor, Joe Biden, before e go into effect for March 2021.
Na federal court judge bin block am for September 2021 and Biden administration bin withdrawn am three months later.
Di total wages wey dem go pay di H-1B workers go increase to $502 million for di 2026 fiscal year wey go begin for October 1, di notice wey di US statement release, cite di U.S. Department of Homeland Security estimates.
Wage go increase by $1 billion for di 2027 fiscal year and, $1.5 billion for di 2028 fiscal year, and $2 billion between di 2029-2035 fiscal year di statement tok.
An estimated 5,200 small businesses wey dey currently receive H-1B visas go suffer a significant economic impact due to loss of labor, DHS tok.
U.S. Citizenship and Immigration Services, wey bin issue di proposal, go give di public 30 days to comment and e go start from Wednesday, according to di notice.
Di visa dey allow American firms to hire skilled workers essential to fill talent gaps and keep dem competitive.
Some pipo wey dey support di program include Elon Musk, weyb be naturalised U.S. citizen wey dem born for South Africa, na H-1B visa im dey hold too.
Critics dey argue say di program dey allow firms to suppress wages and sideline Americans wey fit do di jobs.
India na di largest beneficiary of H-1B visas last year, and dem bin account for 71% of di approved beneficiaries, while China dey distant second wit 11.7%, according to govment data.
Di H-1B program dey offer 65,000 visas annually to employers wey dey bring in temporary foreign workers for specialized fields, wit anoda 20,000 visas for workers wit advanced degrees.
https://www.bbc.com/pidgin/articles/ckgymz8vv7do
(http://www.autoadmit.com/thread.php?thread_id=5779834&forum_id=2#49301944)